For long, electricity overbilling issue for Nigeria don become problem to many Nigerians.
Many don complain of how Electricity Distribution Companies alias Discos dey over charge dem for “light wey dem no use”.
Dis complaints lead to protests by electricity consumers for Rivers State on Wednesday as dem waka go di office of Port Harcourt Electricity Distribution Company, PHEDC come ask dem to pack comot for di state, sake of estimated billing and over billing.
But how pesin wey get dis same issue fit resolve am according to wetin di Nigerian Electricity Regulatory Commission advise?
Head of Corporate affairs NERC Michael Faloseyi explain give BBC Pidgin say dem get customer complaints, standards and procedures wey pipo wey get issues with dia Discos suppose follow and dis one dey ground since 2006 and e give about six conditions and ways wey customers fit take lodge complain.
“Di first step na for di customer to go lodge complain for di customer complaints unit of di Disco office and we expect say within 15 working days, di Disco go don attend to dat complain but if dem no fit resolve di complain within dat 15 working days, dem suppose carry di customer along and explain to am di challenge wey dem dey get to make di customer dey comfortable.
“If dem no fit solve di complain for dat level, we get di forum office.”
Section 4 of di Customer complaints and external regulation state say e get five members of di public wey go sidon chook eye for di complain.
Dis pipo include Manufacturers Association of Nigeria MAN, NACCIMA, pipo wey go represent di customer maybe one NGO or Customer advocacy group; five pipo wey no come from di Commission. Dis group of five pipo dey all over di kontri wit one staff from di Commission wey go serve as secretary to take minutes of di meeting
“If dem no fit solve di complain den you fit write petition to di NERC and we don get cases wey di Commission don interfere to make sure di customer dey satisfied.” Im tok.
According to di Electric Power Sector Reform Act 2005, di Nigerian Electricity Regulatory Commission NERC get power to manage and ensure ogbonge electricity supply so Nigerians go get stable, adequate and adequate electricity supply.
For quality service delivery NERC don list some rights wey customers get and dem be say:
The prospect of U.S.-Japan alliance seems high Prospects are emerging that the U.S.-Japan alliance will…
Donald Trump has appeared to back the UK's Chagos Island deal Donald Trump has appeared to back…
The World Bank has forecast a positive economic outlook for East African countries in 2026,…
Explosions rock Iran following Trumps threat Two explosions rocked Iran on Saturday and killed at least five…
General Muhoozi Kainerugaba has tendered an apology to the United States Uganda People's Defence Force…
The Five Eyes Crumbles as Trump detonates the seal The Five Eyes (FVEY), a security…